MicHealz – Chiwetalu Agu mp3 download and lyrics

MicHealz – Chiwetalu Agu
MicHealz – Chiwetalu Agu

Verse 1

Everybody wants to be you when you winning
That’s fact
You asked me for money I say I no get you said you are kidding
That’s fact
You no dey you dey talk of time and season
Eh
Cos I no help you, you say I go suffer , Nollywood for a reason

Chorus

Me way I wicked pass chiwetalu agu
Or make I craze for you like patience ozokwor
Dem I go step an down with one baby oku
Na just the different locations Banga na ofe aku

Verse 2

Life no care who you be (who you be)
If you no hustle you no go see food chop
Ololo
Plenty kele dey text me , me I no dey dm
Bad vibes be like centimeters me I no dey c’em
Cos If you win dem go clap you , loose dem go laff you
Life na journey if you chop ur transport nobody go Lap you
My guy hustle no let kele tell you say she no send .
Cos even if she get pure intentions you go still spend
Forget Durex I dey strong. If you dey find the gold make sure say ur circle small
Momsy never chop but you give olosho your gain
Normally you no smart no be codeine dey spoil your brain
Money dey speak any language shii joma pel
Money be like Bluetooth if you comot tooth ipia (tooth I pia)aje
Person way get bottle mark no dey fear tattoo
I know say you don see 99 but 100 fit pass you

Chorus

wicked pass chiwetalu agu
Or make I craze for you like patience ozokwor
Dem I go step an down with one baby oku
Na just the different locations Banga na ofe aku
wicked like chiwetalu agu
Or make I craze for you like patience ozokwor
Dem I go step an down with one baby oku
Na just the different locations Banga na ofe aku

Verse 3

Life na mathematics if you no work sapa is constant
Cos naa when you broke you go know say you no really get contact omo
Forget packaging na akamu dey sell pass custard yes
Na person way get money girls dey carry for head like frontals
Hold your accolades listen to me my PADI
I just want my song to dey for almost every house like flagyl
Same money different hustles so no look down on a brother
Cos nail cutter no know wethin shaving stick dey suffer ezioku
Wake up you wan dey sleep dey leave your dream
Forget Twitter code tree life hustle no be me
I always want to win, you see that L I no dey hold
Cos I be like new money I no dey fine if I fold
Midfield, hate na heavy weight.
No dey carry person for bele you are not their sorogate
If you bill me and I chest I just wan help forget your format
Cos nothing Pablo never see for wallmart

Chorus

Normally I wicked pass chiwetalu agu
Or make I craze for you like patience ozokwor
Dem I go step an down with one baby oku
Na just the different locations Banga na ofe aku
Melo give me beat nah what’s up
chiwetalu agu
Or make I craze for you like patience ozokwor
Dem I go step an down with one baby oku
Na just the different locations Banga na ofe aku

Listen & download below:

Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *